Story : Brouhaha In The House Of God ( 16 + ) - Season 1 Episode 2 - Stories


I heard a big sound from our front like a splash or something, i look that area i nor see anything.
Felix: wetin be that?
Me: e be like say na big fish oh but i nor see anything.
Then i heard the sound again, this time closer omo this fish go big oh, the thing they swim come meet me self with boldness, i never still know wether na fish or not and i don dey fear,
Felix: commot for river, na big fish be that oh make i face am alone.
I ran out of the big river while felix stood at the middle holding his matchet like matchete with confidence like rambo.
Then i saw it from where i stand, a very mighty fish like arrow head, swimming close to felix, i started shouted shouting.
Me: bros bros commot for the river, that fish too big oh e get arrow head oh, you nor go fit kill am.
Felix: keep quiet make you nor scare am that chemical don weak am so e no go dey strong no worry my guy.
Omo make una come see action film, as the fish swim closer to felix, felix rose his matchet and hit the fish on the head, then there was silent, no blood, nothing at all, after a minute something took felix down the river, then the thing started dragging felix to the bottom of the river, i ran after it shouting, make una help oh, make una help oh something don carry felix oh.
The thing they drag felix to a very deep place and na only God go help am if them enter the deepest,.
Then from nowhere, i saw my brother and other people running after me from my back, e be like say them hear my voice.
Cactus: oz wetin they happen,why you they shout and run,.
me still running after the fish breathing heavily, point at felix as the fish continue dragging him, my brother saw it see the way wey im take run pass me like usain bolt them say him dey win 100 metre race for school i nor believe but now i believe (we nor go the same school)
Source:waploaded