Story : Brouhaha In The House Of God ( 16 + ) - Season 1 Episode 1 -
Me and my friend Austin coming back from school after a notorious exam.
Me: guy where them put you na i nor even see your signboard OR breaklight self.
Austine: omo na ss3 class them carry us go oh, and na that wicked chuks be our supervisor.
Me: chai see punishment, that means no show for una side be that oh.
Austine: no show at all the exam worse pass jamb self, the thing really hard, na where you dey self.
Me: i dey multipurpose na.
Austine: see luck oh, there wey people many, them nor go even know who dey do expo.
Me: na so oh, even me expo wey i write for my sleepers all of them clean, na person book i tear commot oh.
Austine: wicked boy, but you dey mumu oh, you nor know say the thing go clean before?
Me: i nor reason go there at all, abeg make we waka fast i get choir practice today.
Austine: that una choir wey una dey Bleeping Bleeping each other so.
Me: thuunder fire that your mouth, which kind Bleeping Bleeping be that.
Austine: hahaha even i hear say una choir master dey Bleep two of una girls.
Me: na lie joor, na rumous, all those people wey dey carry fake fake rumous waka na God go punish them.
We continue trekking, our school is very far from our house, e take us 50 minutes from our house to school, sometimes i do get free bike base on say my mama na nurse and they know her for that community well well, meanwhile i be choir member for one anglican church, and we get beautiful girls with big hips ?.
I got home exactly 4:00pm, our house dey opposite hospital wey my mummy they work, na primary health care government hospital, i open door enter house saw my elder brother cactus im senior me with 3 years i greet, i drop my bag and check pot omo nothing dey pot, i enter room carry 50 naira from container, i went outside to buy head of fish, i came back and use the fish to sama garri, after eating i went straight to my bed to sleep at least i have like one hour left before the choir practice start, so i decided to sleep, as i they put my head for pillow i see my brother they carry cuttlass and bag.
Source:waploaded.com
