HAD I KNOW :episode 3
Later on, Joseph is seen in the room playing temple run on his android and updating Victor(Chinedu’s other roommate) on what happened while they were out.
Joseph: guy, if to say you see this babe wey i dey tell you, front eeh, mehn, God really bless some girls sha.
Victor: (laughing) so tell me the babe don agree?
Joseph: (contemplating) i no really know sha o but with the way wey i sight her dey laugh before me and ken con commot i no and i sure say. her saying Yes na sure banker.
Chinedu is seen heading to his room, smiling and singing to the song (Jason Derulo’s marry me) playing on his Mp3
Chinedu: a hundred and five is the number that comes to my head when i think of all the years i wanna be with you, wake up every morning with you in my bed that’s precisely what i plan to do….(enters the room)….guys whatsup nah.
Victor: (pretending like he doesn’t know why he is excited) Oh boy, we dey o, this one wey you dey happy like this you don hammer for bet9ja neh?
Chinedu: leave that one, that one nah small thing, the one wey i hammer na that one times hundred…(turning to Joseph) guy you and Ken una no do well o!
Joseph: wetin we do?
Chinedu: why una con commot nah without informing me?
Joseph: mtchweeeeeew na that one, wait o you been they expect us to sit down there like pikin wey e mama loss they watch you and the otepu dey laugh like say tomorrow no dey, sorry sha no vex, I go run my own package
Chinedu: apology accepted…wey ken nah?
(just then Kendrick walks in and they all turned to look at him as he was holding an empty stainless plate and they all knew what he came for again…his usual thing)
