Of course we went to farm that morning, we came back by 3pm in the evening, and we have choir practice by 6pm (na festive period so choir practice is everyday now) i went to the river to fill our rubbers for like 6 times, when i return i took my bath, eat and sleep, i wokeup by 5:30pm, i wear my clothes and spray my mummy perfume, i took 200 naira from her container, she always keep money there for us incase of emergency, i hed to my church, i reach there 5:40pm, na only our fat choir mistress (mary) they church.
Me: good evening.
Mary: welcome, this one wey you quick come today so, wetin happen?
Me: so i nor they quick come before, i said as i took sit beside her, i look at her note.
Mary: you dey always late na, what of your brother na (e don tey wey she dey find my brother, but my bros just dey shun her.
Me: my bros they house, go see am make u nor dey always ask me about am again oh, abeg give me that song wey we sing last time i wan write am.
She gave me the song while i balance on one table and start writting, time 5:50pm people never still come.
Me: wetin happen wey people no quick come today na?
Mary: you nor hear?
Me: hear say wetin?
Mary: mabel brother die na for auchi poly.
Me: whaat, abeg which mabel you they talk about.
Mary: our mabel for choir here na, them say na cultist im be, na im be oga self, but as im don die now na him younger brother be leader, the one wey senior mabel.
Me: this is serious,
Mary: very serious because them say na cultist kill am, and mabel brother say them go revenge,
Me: na wa oh, na im make i dislike cultist.
Mary: me i nor even know wetin them they gain for cultist oh.
I was confuse i for say make i call mabel and greet her but i dont have her number off head,.
So her brothers na cultist, hmmm i better stay clear that family, as if my mama no be cultist.,
after fifteen minutes or more people start coming one by one till we have a full house, we prayed and start.
By 8:15pm i called tina after we close, i told her am coming, she said okay that she will prepare jollof rice for me, when i hear jollof rice my belle sweet me.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
