Story : Brouhaha In The House Of God ( 16 + ) - Season 1 Episode 6 -
“fiaah” that kobok na die, na so i dey cry loudly like small pikin, me wey teach they flog tire for school i nor they even cry, maybe this man na retired general, he continued floggin me till e reach 10, then mabel who have been watching cry inside e be like say she nor fit bear am again, just because i flog your koboko na im make your papa wan revenge abi? No wahala after today when i see your break light i go disappear,.
The man flog me fifteen good times on my fine yash, come see as my yash dey like red volcano .
Daddy: untie him and throw him outside.
John over sabi head just untie me, junior open their door and john push me outside as if i steal something, oh yeah i forgot i stole her virginity, but i didnt steal it na she gave it to me willingly, na so them push me outside even without clothes, and my phone too they inside mabel room, i they waka dey bend my yash like goat wey them break im back leg, i manage to walk to the main road, i tried to sit at the gutter to regain my strenght before trekking home, as i sit down omo na so my yash pepper me, so i just better stand there hold pole like say them wan crucify me like Jesus, i stood there for like 10minutes then i started walking home, in the midnight wey nobody dey road, well thank God say moon they sha, i walk slowly using my right hand to cover my dicck even though na night we they.
I walk slowly till i get to the church, i look at the church i shake my head, assuming i come house directly now this calamity for nor happen, as i continue walking then i heard sound from my back, i look back and saw somebody wearing white clothes following me from my back, i fasten my footstep. Any demon that want to form evil against me shall not prosper in Jesus Name.
I started moving faster and faster, i look back and saw the person abi ghost making a call, i cant figure the person’s face but am quite sure that she is a female, i continue walking faster then withing 2 minutes i look front and saw 2 other people coming from my front, omo na which kind wahala be this na, i look back i did not see the other person again but i believe shes coming so i corner and enter one road in between two houses to move to the older road, as i came out of the street i saw another white person standing, resting her body on a pole, pressing phone, i turn back, as i move two step i saw them again coming towards me, they no even waka fast them just they stroll like say them they use me play game of chess, by this time in the midnight wetin person like me go fit do, wey my yash they pepper me, i stood still while two approach from the back and two from the front all of them girls, i set my blow ready for fight while my dicck bounce with me, at least before i go down i go don fall like two of them, then i saw another person coming, this one look like their leader because her clothes is different but still white, she came and walk pass their middle, she came closer to me and remove her mask.
