Story : Brouhaha In The House Of God ( 16 + ) - Season 1 Episode 12
We finish the service in peace by 1pm before then tina don they disturb my phone since say make we dey go house when preaching still dey go on, lol i guess shes not use to it, i told her to be patient that it is not good to leave the service without sharing the grace, she manage to hold on till we recess out, glory be to God at last service don end. i went inside and took my bible , i saw mabel coming over to my place, i quickly enter the dressing room and remove my garment i pass there come outside, why this girl dey do me like this na, she know the kind of suffer wey i suffer last time, or she nor dey pity me self, since that flogging every love wey i get for her disappear and as tina don come back na i dont think there is any possibility for me and her to be together again.
I ran outside the gate and saw tina standing at the back of the car,.
Tina: wetin come delay you like this?
Me: we been they discuss one issue like that choir stuff, make we they go na (i dont want mabel to meet us outside).
I enter the front seat while she balance at the driver’s seat, she start the car, reverse and sped off, i look at the side mirrow and saw mabel coming out of the gate, looking her left and right as if she is looking for somebody, i just smile for my mind, na later wey my head come down i come know say no be my house we dey go.
Me: where are we going.
Tina: house.
Me: which house?
Tina: mine of course, any problem?
Me: no its just that i was expecting you to drop me at my house first.
Tina: i will drop you later in the evening dear lets go party.
Chai so me no go carry my blessing reach house na abi, no wahala the blessing wey my brother and my mum go carry come from their church go cover all of us, we drove silently then tina started looking at the side mirrow suspiciously i dey watch her as she continue to look at the side mirrow.
Me: why do you keep on staring at the mirrow like that?
Tina: that black suv car has been following us since we left church.
I look back and saw the black car following us, so tina put more fire for the jar and start driving faster, the person fire im own motor too, oboy fear don they catch me oh e be like say na film i dey watch.
Me: who are they and what do they want?
Tina: i dont know, but dont worry i will take care of it, give me my phone inside the bag.
