Story : Brouhaha In The House Of God ( 16 + ) - Season 1 Episode 15
We ran inside the bush like mad men, who go see fire and stand they look, i don watch those kind things for tv but now e dey happen to me e just be like film trick, they kept on shouting at us to stop or they will shoot, that one fall for deft ear, we run for our dear live, since we dey familiar with the area we escape from them and run back to our school we found ourselve back to school breathing heavily with our tattered uniform due to the bush, everybody don go house so the school dey empty we waka go the last class.
Austine: guy na who be those guys?
Me: i nor know them oh, but e be like say na me them dey find.
Austine: why wetin happen?
Me: you know celestina na abi?
Austine: that tina wey be oga for white angel?
Me: yes na, she don come back.
Austine: ha since all this while she gree return and i believe na she go cause all this trouble.
Me: she say something happen for auchi so she run come back because auchi dey too hot.
Austine: wetin come concern you wey them want kidnap us.
Me: e be them know say i dey close to tina,
austine: so them want use u capture her.
Me: exactly, na wahala i dey oh.
Austine: how them take know say you know her.
Me: i never know.
Austine: okay bye bye, and nor come my house again oh.
Me: wetin you mean.
Austine: na you them dey find no be me, i nor want associate with cultist things abeg.
Me: so you want come leave me here abi? We nor be friend again?
Austine: for now the friend is on hold, till after redemption.
He meant it because he walk out on me leaving me inside the class, i called him back but he refuse to come back, i ran after him.
Austine: abeg no follow me abeg, just waka your own make them no see us together at all.
Me: why you dey do like this na, okay give me your phone make i call person.
Austine: take and nor follow me again, infact carry the phone i dash you.
He gave it to me and leave me like that standing stranded.
I look left and right i thought i saw someone starring at me, so i ran back inside the building, i took the phone and dial tina’s number, (she ask me to memorize her number incase of emergency) i dial the number no answer, i dial it again, this time she pick up.
